Boat aksident: Libyan Red Crescent don recova four pikin dead bodi
Dead bodi of four pikin wey no pas 10 years for age na im dem don recova for de side of water wey dey Libya afta de boat wey cari dem dey waka get aksident com enta inside de water on 16 December, na so de Libyan Red Crescent tok.
Hassan Mokhtar al-Bey wey be staff for Red Crescent, com tok say de boat cari 30 pepul dey waka before e com sink for Zawiya side for Libya.
E com tok say three dead bodi na 45km from Tripoli na dea dem see am, and de fourth dead bodi na from far west, na dea dem see am. But, dem still dey find de oda passengers wey dey inside de boat; dey neva see dem.
Plenty migrants don die as dem wan folo kurukere way take enta Europe from Libya.
TMP_20/12/2020
Photo credit: Shutterstock/Alex Spatter
Photo caption: Libya’s side of the Mediterranean during a storm.
Make una share dis article