Ova 50,000 waka abroad pipu don leave Libya by demselves since 2015
More dan 50,000 stranded waka abroad pipu for Libya don choose to come home to deir home country since 2015, according to de International Organization for Migration (IOM).
De waka abroad pipu wey come from 44 kountries, dey among de thousands of waka abroad pipu wey dey try to reach Europe thru Libya and de Mediterranean sea.
According to de IOM, more dan 1,300 waka abroad pipu don return by demselves to deir home kountries in 2020 alone, unda its Voluntary Humanitarian Return programme.
Since April 2019, Libya don dey inside plenti division and political fight, wey don lead to de dying of plenty pipu, including waka abroad pipu. At least 60 waka abroad pipu get killed and more dan 130 dey injured for inside airstrike ontop a waka abroad detention centre for Libya for 3 July.
Bcos of de gbege fight wey dey Libya, thousands of waka abroad pipu no dey able to get humanitarian, medical and security services. As a result, dem dey find way and opportunity to return to safety.
TMP – 23/03/2020
Photo credit: Shutterstock/Tayvay
Photo caption: Abuja, FCT Nigeria- October 4, 2019: Cross-section of Nnamdi Azikiwe International airport Abuja at night
Make una share dis article