Dem don save many African migrants for Sahara desert
African migrants wey go reach like 83 in numba, na im dem don save for Sahara Desert where dem don alredy dey stranded, na so International Organization for Migration wey be IOM com dey talk.
De pepul wey dem save na like 41 women wey com from Naija, twin girls wey dey four years old and 42 men wey com from Naija, Ghana, Mali and Togo. Before dey save dem from dat dangeros desert road wey don dey kill many pepul sinc time imoriva, dem don sufer so tey water no dey dea bodi.
Na IOM na im com join bodi wit de General Directorate for Civil Protection (DGPC) in Niger, and de European Union to go save dose pepul on 3 September.
TMP_15/09/2020
Photo credit: Shutterstock/Torsten Pursche
Photo caption: Migrants wey wan folo de Sahara desert take enter Chad as dem dey for de back of pickup truck, November 8, 2017, Chad
Make una share dis article