EU migration policy: Wetin e mean for Africa
The European Union (EU) don dey struggle make them find solution wey them go take reduce the large number of kurukere people wey dey waka enter for their land. If you check the number of laws wey dem don bring out plus including the kind leaders wey dem don dey select and the way wey those leaders dey talk about this illegal waka, you go understand wetin dey. And if check am well well, you go understand sey Africa dey gidigbam for this matter wey dey ground.
E don reach three years wey this matter of kurukere people from African and Syria wey dey enter Europe don dey give serious headache to Oyibo. For 2015, when the matter dey hot, kurukere people wey pass one million na im enter Europe by water. For inside that number, 4,000 na im dem talk sey die. Another 360,000 kurukere people na im dem talk sey try to enter Europe again by water. The number of kurukere people wey enter Europe for 2017, na half of the number wey enter for 2016.
Na Africa na dem pass for all the people we dey enter this bad journey. Many of them na from Nigeria, Libya, Niger, Tunisia, andThe Gambia. Dem dey always talk say na bad economy for their country and fight fight wey always happen there, na wetin dey make them dey travel all the time.
People wey come from Burundi, Eritrea and Sudan also join but their own be say, dem dey seek asylum over there. But, the thing wey dey there be say whether na the asylum seeker or na the ones wey wan make am big, both of them dey head to Europe and dem dey follow kurukere road wey dey very dangerous.
This kurukere waka to Europe don become serious gbese for the people of Europe and their country and also for African countries. Na wetin make 28 leaders of European Union (EU) countries for two days in June, to take know wetin be the way out.
For that meeting, dem reach agreement say people be asylum seekers, dem go give them help but for those wey dey waka because say dem wan make am big, dem go return them to their papa country even before dem go reach Europe.
Africa understand wetin Oyibo wan do to means say dem get screening centres for many North African countries where this kurukere people dey follow dey enter Europe through the big sea.
If dem implement the plan, na im be say hose wey dey die inside the sea go reduce well well. E go also helep to discourage the wicked people wey dey deceive others people to enter this journey and also those wey wan enter the journey on their own.
But, report talk say many North African leaders no gree to plan by EU. The joinbody for all African wey be AU don talk say dem go create place wey Africa go stay to watch wetin the happen as per kurukere waka. Dem call am African Observatory for Migration and Development (OAMD). The AU also talk say all African countries wey be member of AU go establish wetin dem call “control centres” throughout the EU so that e go helep them to know who be who for this kurukere waka.
This matter don dey cause gebege for the country of Europe and the way wey the matter be now, even the two days meeting no go solve the whole wahala wey this matter done create.
Any how wey person take look at this matter, the koko be say EU don stand gidigbam say dem must arrest this bad development for their continent.
TMP – 02/08/2018
Photo Credit: www.thesun.co.uk. Prime Minister for Germany, Angela Merkel and French Presido Emmanuel Macron after the EU agree for the deal wey go make migration easy in June
Regista for waka abroad informate
Make una share dis article