People wey dey helep waka waka people for Hungary fit peme now ooo
For June 20, Hungary don make plenty laws sey any person or people wey helep waka waka people or people wey wan enter the country anyhow without better pale, sey that helper go become criminal and fit go prison talk of sey na crime dem don commit.
Dem don call de law “Stop Soros” as pa sey na e get one man wey hin name na George Soros wey the Hungary gofament don talk sey him dey helep waka waka people wey be Muslims. Dis new law give the gofament power to send anybody and company go prison if dem reason sey de person dey helep waka waka people enter dem country anyhow, na so BBC talk.
De law wey dem change for Hungary talk sey “person wey no be country man” no fit tanda for Hungary. Dis law no con dey for de same level with European Union wey wan helep 150,000 000 Eritrean, Syrian, and Iraqi waka waka people wey dey beg to tanda for Europe.
Plenty people don talk sey dis new law eh, no be better thing for Europe. Dem include the Council of Europe, the Organisation for Security and Cooperation in Europe (OSCE) and Amnesty International. BBC dem talk say, de body wey helep Refugees for the world, tell Hungary make dem throway de law. Dem person sabi law for Council of Europe sef don hamma the law talk sey e too much and e no follow Europe laws dem.
De vote on top de matter shele wen some Europe ogas dem wan bin yarn on Friday on top how dem go change de asylum (people wey dey beg to tanda for Europe) matter, na so de BBC talk.
Hungary talk sey waka waka dey make dem country no secure. Sándor Pintér, Hungary Minister for inner matter talk sey the people dem look make gofament do everything to quench the waka waka enter the country wey dey illegal and the things wey dey support dem, na so The Guardian talk.
Pintér con talk sey na dis “Stop Soros” go do de job wey go stop companies dem wey dey helep illegal waka waka people. “We wan take the laws dem stop Hungary make e no turn to country for waka waka people,” na so hin talk.
Illegal waka waka don be strong matter for people wey dey vote for Europe, e dey help people wey no want waka waka people for Italy and Austria dem and e still dey break Merkel three-month-old parapo for Gamini.
TMP – 28/06/2018
Regista for waka abroad informate
Make una share dis article