Nigeria: Edo don receive almost 5,000 returnee from Libya in two years
Since 2017, de Edo State govament don claim say im receive and arrange 4,943 pipus wey don hook for inside Libya.
De pipu wey come back, get inside dem about 214 wey be shidren, and dem don be irregular waka abroad pipu or pipu wey enta wan chance of human trafficking. As dem strand for inside Libya, dem dey risk of make dem enta gbege wan chance, wan chance arrest and make dem dey for inside middle of de gbege wey dey go on.
For dem response, for news conference for inside Benin, Yinka Omoregbe, Chairperson of the Edo State Taskforce Against Human Trafficking (ETAHT)talk say, de Govament of Edo State don spend over NGN 300 million (USD 845,000) for de last two years on top, say make dem hepp to assist returnees settle and enta back inside society.
For part of de programme to settle returnees back, de state govament talk say it dey construct permanent homes wey go accommodate indigenes wey don strand for obodo oyinbo land.
“De facility go assist state govament to dey strong to dey fight against human trafficking and irregular waka abroad as dem go dey give returnees plenty guidance and counselling session. Dis go give dem beta chance to succeed,” talk Mr Crusoe Osagie, Special Adviser to de Governor on top Media and Communication Strategy.
Omoregbe also note say de task force dey work with stakeholders to dey tell de public about de dangers of irregular waka abroad and human trafficking, as wellas dem dey provide support system wey go hepp returnees for de state.
She talk say, “dem also dey involved to investigate and arrange for court dose wey dey carry out dese act and dem dey find out wetin be de cause of trafficking. As well, she talk say dem dey warn pipu against danga wey dey inside to travel out thru illegal means.”
Omorogbe also tell journalists say de task force’s achievements don change de way the international community dey look Edo State. She talk say: “Our efforts for Edo State don dey acknowledged internationally.”
Edo, a Southern state in Nigeria, na hotbed for irregular waka abroad and human trafficking. For early 2000, dem talk say, de majority of African sex workers wey dey Italy na from Edo State.
TMP 19/09/2019
Photo credit: www.vanguardngr.com
Photo caption: Libya returnees as dem arrive for Port Harcourt International Airport, Rivers State, Nigeria.
Make una share dis article