Dem don catch plenty waka abroad pipu for English Channel for one day

 

New record don dey for de numba of irregular waka abroad pipu wey dey try to get to UK thru de English Channel as dem stop 145 pipu on top eight boats in wan single day. De mata happen for 8 May. De day wey follow, dem catch anoda 82 waka abroad pipu. De waka abroad pipu na Iranian, Iraqi, Kuwaiti, Syrian and Afghan pipu.

Minister for immigration compliance Chris Philp tell BBC say smugglers dey put pipu’s lives for danger wey dey very bad, he talk say de UK government go chase and carry all de criminals wey dey do dese ogbonge crimes go court.

Home Secretary Priti Patel don link de increase of crossing numba to de COVID-19 lockdown wey dem announce for Britain for 23 March . Na about 836 waka abroad pipu wey UK border forces don catch and stop since den. 

TMP_ 14/05/2020

Photo credit: Royalty-free stock photo ID: 1280552026 | Susan Pilcher

Photo caption: Greatstone, Kent, Great Britain – 31st December 2018. UK Border force officers inspect a small rib on the beach There are reports that this craft contained 12 migrants