France: Waka abroad pipu still dey sleep rough as coronavirus cases increase

Hundreds of waka abroad pipu and asylum seekers still dey sleep outside for inside de coronavirus wahala and lockdown measures wey dey happen for France.

On top warnings wey dey come from NGOs about de poor sanitation condition wey homeless waka abroad pipu dey face, authorities don start to relocate residents go temporary camp for Paris area of Aubervilliers to hotels and sports centres. More dan 700 waka abroad pipu na im dem comot, but hundred or even thousands of waka abroad pipu still dey for de streets.

De situation also dey more and more challenging for waka abroad pipu wey dey for de north of de kountry. For Calais, waka abroad pipu dey live for inside a “ogbonge dirty condition”, according to BBC’s Fergal Keane. Pipu wey dey live for inside dese makeshift camps dey live very close to each oda and no get enuf access to sanitation facilities and food. Many charities don also stop deir operations, which con leave many waka abroad pipu more helpless.

As at 19 April, France don report ova 150,000 cases of coronavirus, and ova 19,000 deaths.

TMP_ 21/04/2020

Photo credit: iFocus Royalty-free stock photo ID: 1133363405

Photo caption: PARIS, FRANCE – JULY 4, 2018: A homeless person sleeps under a tent near a public garden on July 4, 2018 in Paris, France.