France clear last makeshift waka abroad pipu camp wey dey for northern Paris

French police don move anoda 427 waka abroad pipu from de last makeshift camp wey dey for inside northeast Paris for 4 February. Dis clearance na im mark de end of effort wy dem take to scarra all de camps wey no dey formal dat don spread around de capital for recent years.

Waka abroad pipu, plus include four women, dey live for inside 266 tents and makeshift shelters. De camp, dey for de edge of Canal Saint-Denis, and “plenty dirty dey all around am”, “rat don take ova” and it dey smell strongly of “piss and poopoo,” according to authorities.

About de operation, which last two hours, Parisian police talk say, “de evacuation for de Porte de la Villette don put end to camps wey dey create sanitary risk for de area and security risk for dose wey occupy dere and wey dey live dere.”

Some police officers stay for de site so dem go stop waka abroad pipu make dem no come back to set up anoda camp dere. “We no go repeat cycle of evacuation and relocation wey no go finish,” Paris police chief Didier Lallement said.

Dem relocate de pipu wey dey live for de camps quick quick to reception centers where dem go quickly process deir asylum applications. 

TMP – 13/02/2020

Photo credit: Harriet Hadfield / Shutterstock

Photo caption: PARIS – MAY 5, 2017: Tents wey dem put for inside urban waka abroad camp for de ring road for northern Paris.