Ship accident for Libya don kill 15 migrants

Pepul wey go reach like 15 na im water don swalo. De International Organization for Migration wey be IOM tok say na wen dem wan enta Europe na im de ship wey carri dem dey go com enta inside dat big water wey dem dey call de Mediterranean Sea for Libya side. 

Dem com tok say de ship na from de Zawya town for Libya na from there e start de journey on 18 October befor e com get de accident. Fishermen, na dem save about five pesin, com car idem go for Sabratha town on 20 October, na pesin wey dey tok for IOM wey be Safa Msehli, na im tok dis one. 

De oga for IOM wey dey for Libya wey be Federico Soda, com dey tok say de Libya coast guard don kach pepul wey pass 70, com cari dem go bak to Libya. 

From January go reach October 2020, de water don swalo over 200 migrants and anoda pepul wey pass 280 don dey miss. Dis na pepul wey wan folo de Mediterranean take enta Europe, na so IOM tok. De whole numba of pepul wey dem don retun for Libya dis year go pass 9,800.

TMP_ 28/10/2020

Image Credit: Shutterstock/Riccardo Nastasi

Image Caption: Abandoned migrant boat