NAPTIP’s mission make dem catch traffickers wey dey do cross-border

De agency of Nigeria wey dey in charge of make dem no dey traffick human being, wey dem dey call de National Agency for de Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP), don call for de arrest and trial of ogas of traffickers wey dey live for obodo oyinbo all across de world.

De Director-General, Mrs Julie Okah-Donli, talk dis matta recently when she take receive de visitors wey come from de Spanish embassy for Abuja.

De NAPTIP boss talk say, de actions of dese foreign-based traffickas na major danger to de general world work of de anti-human trafficking campaign.

Okah-Donli come tell membas of de European Union and oda international organisations make dem give informate wey useful on de place wey dem dey operate from and location of Nigerian traffickas, so dat NAPTIP go fit arrest and send dem go court.

She tell de pipu wey dey visit dat getting dose Europe-based human trafficking oga go be big hepp to dis fight wey dey ground against human traffickers.

“De arrest and carrying to court of dose human traffickers wey dey based for European country dey very important to our efforts for now to comot human trafficking for inside Nigeria. We beg una to join hand with us for dis area of informate sharing wey go aim to show dose foreign-bases human trafficking madams, who we believe dey behind and dey exploit awa young pipu.

“We wan make dem dey expose and make dem dey punished by de law. Dis na wan of de ways wey we fit make sure dat de latest fight against human trafficking dey successful,” she said.

De leader of de Spanish delegation talk earlier say de delegation visit NAPTIP to informate its oga dem on top de 11th European Development Fund Project which get aim at dealing with some of de issues wey consign human trafficking for inside de country.

De main objective wey de project get na to reduce trafficking of persin and de smuggling of waka abroad pipu, both for inside Nigeria and to Obodo Oyinbo abroad countries, with eye on top women and shidren.

TMP – 14/08/2018

Photo credit: www.naija.ng. (Human traffickers wey dem suspect wey NAPTIP catch)