Rwanda go receive de first 500 waka abroad pipu wey dem komot Libya detention centres

Na hundreds of African waka abroad pipu dem go komot from detention centres wey dey Libya go Rwanda in de weeks wey dey come. Dis move na plan by de African Union, de Rwanda government and de UN Refugee Agency (UNHCR).

De three actors make de deal, which dem don describe as “life-saving” by UNHCR, to protect dem wey dey consign by de violent gbege wey dey go on for dere and de poor humanitarian condition wey dey for Libya.

De first set of 500 pipu, wey include waka abroad pipu from Eritrea, Somalia and Sudan, dey expected to land Rwanda for de weeks wey dey come. Rwanda go divide dem for groups of 50 and go give dem palce wey dem go dey live and security for transit facility for outside de capital, Kigali.

De UNHCR go den hepp dem to resettle refugee for oda kontry. Oda waka abroad pipu go dey return to deir kontry wey dem come from if it don dey safe make dem do so.

“Dis na expansion of de humanitarian komot to save lives,” talk Babar Baloch, UNHCR spokesperson for inside Geneva. “De focus na on top dose wans wey still dey trapped for inside Libya. We don see how ogbonge de condition be and we wan komot dem from inside trouble way.”

Rwanda don talk say, “We go give dem space, we go give dem status, we go give dem residence permit. Dem go dey live legally for Rwanda as refugees,” talk Vincent Cochetel, de special envoy for de UNHCR for de Central Mediterranean.

Na about 4,700 waka abroad pipu dey currently dey detained for inside Libya, according to de UNHCR. Na at least 60 waka abroad pipu wey dem kill and na more dan 130 wey dem injure for inside airstrike for wan waka abroad detention centre wey dey Libya for 3 July.

Many waka abroad pipu dey also trapped for shameful condition and dem dey face gbege, kidnap, rape, slavery and even murder. Afta video wey show how dem dey sell waka abroad pipu for slave auctions for Libya in 2017 Rwanda don gree to take in 30,000 African waka abroad pipu from Libya ova de following years.

“De desperate situation wey dey Libya dey disturbing and we dey prepare to give support and  wey dem fit stay to awa African brodas who don hook for inside the immigration problem for inside Libya, and who dey ready to move to Rwanda,” President Kagame talk  last year.

De UNHCR don claim say dem don komot more dan 2,900 from Libya to Niger and almost 2,000 of dem don get resettled for different parts of Europe, Canada and de United States.

Rwanda na de second African kontry wey accept waka abroad pipu from Libya, after Niger.