France and Italy don call for ‘automatic’ distribution of waka abroad pipu across EU kountries

Make de European Union introduce system wey go automatically distribute waka abroad pipu across de EU, talk de leaders of France and Italy for 18 September.

Dem make dis joint statement, afta meeting wey hold in Rome between French President Emmanuel Macron and Italian Prime Minister Giuseppe Conte, and dem call for EU kountries to share de responsibility for kurukere waka abroad pipu wey dey arrive for Southern European kountries.

With de proposed system, Italy fit dey expect dat incoming waka abroad pipu wey dem rescue from de Mediterranean go dey automatically be distributed across de 28-kountry bloc with four weeks. Dem also suggest dat penalties be imposed on EU kountries wey refuse to take part in de distribution plan.

Macron talk say “de European Union no show enuf solidarity for kountries wey dey handle first arrivals, and which be Italy mostly. He add say, “I dey convinced dat automatic European mechanism na wetin dey needed for receiving waka abroad pipu.”

De two leaders meet so dem go try to manage de poor relationship wey dey between deir kountries inder Italy’s former interior minister and leader of de far-right League party, Matteo Salvini. Salvini dey regularly block ship wey charities dey manage wey dey carry waka abroad pipu from docking for Italian ports.

“De issue of waka abroad no suppose de fuel anti-European propaganda,” Conte talk.

De interior ministers of Germany and Malta support de automatic redistribution scheme at meeting with de French and Italian interior ministers for de 23 September. De four kountries go bring deir proposal to larger meeting of interior ministers for 8 October. 

According to de Italian Interior Ministry, na almost 1,200 waka abroad pipu don reach Italian shores for de first eight days of September. Dis dey higher dan de 947 arrivals for de same period last year. However, de total numba of waka abroad pipu wey don arrive for Italy since de beginning of 2019 dey 70% less dan January to mid-September of 2018.

TMP 30/09/2019

Pishure Tori: Milan, Italy – February 16, 2017: Plenty pipu wey tanda gidigba for de Immigration Office for Italy. Wahala dey Italy now on top rufugee mata on to say war dey for North Africa and Middle East.

Who get pishure: Alexandre Rotenberg