Italy introduce new law wey leave waka abroad pipu homeless and no get protected

Many waka abroad pipu for Italy dey get problem for de streets and dem no get protection again afte a de parliament approve new immigration and security law. De “Salvini decree”, which carry im nickname from Matteo Salvini, de Italian interior minister, get approved for 28 November 2018.

For way to reduce de waka abroad pipu population for Italy, de new law don bring hard things, wey include: de eliminate of caring shield for dose wey no dey qualified for refugee status; de extension of de maximum time for detention for waka abroad pipu wey dey inside repatriation centres; de allocation of more moni for deportation; and de extension of list of crimes for which dem fit comot refugee status.

De decree also don adjust de criteria wey dey give chance for accommodation for inside asylum seeker and refugee reception centres. From now and to dey go, na only small pikin wey dem no follow and dose who dem qualify for international protection go dey put for inside de facilities.

Just days afta dem bring de law into effect, de representative of de interior ministry for Crotone, a province wey dey de region of Calabria, order say make dem comot 24 waka broad pipu from inside a local reception centre. De waka pipu wey dey comot include a husband and wife wey get a five-month-old pikin, a boy wey get mental health problem, and two pipu wey be victims of sex trafficking.

De Red Cross, togeda wit de town hall and oda charities, don try to accommodate de pipu wey dem comot for inside temporary shelter. Describin wetin im see for Crotone as “crazy”, de head of Red Cross in de area, Francesco Parisi talk say: “You no fit just leave pipu wey dey weak for de street. Dis na violation of human rights.”

Asylum seekers for Potenza, a city for de region of Basilicata, and Caserta, a province for de region of Campania, dey also recently removed from centres. Hundreds more dey expected to receive de same treatment for de weeks wey dey come.

Carlotta Sami, de spokeswoman for de UN refugee agency, UNHCR, for southern Europe, speak out against de evictions, and she talk say: “We not fit understand why, for dis time, dem tell even persin wey get legal protection to leave. De decree no dey backdated, so why dem dey tell dem to leave?”

“Wat we don see recently dey make us think say, dem go be negative effects not for just pipu wey dey weak, but also for de Italian society generally as pipu go enta into officially illegal status.

TMP – 29/12/2018

Photo:  Kristi Blokhin / Shutterstock. Rome, Italy – September 4, 2018: African refugee homeless man lying on sidewalk ground.