Financial Gbege

Una dey wonder about how much it go cost to reach Europe when una no have de required visa? De price of an irregular waka to European kountry no dey fixed. De amount una go pay depend on plenty factors, such as which road una take, de smugglers una use and de type of transport.
Usually waka abroad pipu dey set off on de waka with a price in mind, but as dem dey travel, de amount of money dey owe dey increase. Dis fit happen, for example, because kidnappers dey demand for ransom or waka abroad persin come sick and have to pay for medical assistance.
If una dey consider to waka abroad irregularly to Europe, reading abot de financial costs fit hepp una make a more informed decision about una future.
Call awa waka abroad experts for real informate about waka abroad
From Monday to Friday (9am – 4pm)
If na for Yoruba, Pidgin, English +234 816 922 9349
If na English, Pidgin +234 806 163 7956
WhatsApp and messages also dey possible.
All calls dey confidential

Potential waka abroad pipu from various West African kountries don talk say dem think say de journey go cost around USD 1,000, while odas estimate de price go be between USD 4,000 to 6,000. Dese estimates far from de reality for many cases. In fact, some Nigerian waka abroad don talk say dem pay up to USD 24,000 for de entire waka.

De prices dat smugglers charge dey constantly change, but de waka across de Mediterranean Sea from Libya to Europe fit cost up to USD 3,000. It no dey unheard of make waka abroad pipu make de expensive and dangerious journey all de way from West Africa to Libya, only make dem come return to deir home country because de price wey de smuggler charge dem to cross de sea to Europe come turn out to be so high.

Many waka abroad pipu no dey aware of how much de journey to Europe go cost. Smugglers go exploit waka abroad pipu’s weaknesses. Dem go tell waka abroad pipu say de route to Europe dey safe and cheap, and go promise de waka pipu say dem go find job opportunities for transit countries. But de reality dey usually different.

Smugglers dey often take advantage of waka abroad pipu’s weaknesses and dey ask for more money plenty times on de journet to pay for food and accommodation costs or to bribe officials. For some cases, waka abroad pipu are held hostage and dem go force dem to pay money in exchange for deir freedom.
Pay-as-you-go systems, where waka abroad pipu dey pay for wan leg of de waka at a time, dey become more popular. Dese schemes dey make waka abroad pipu even more exposed to abuse or extortion.

Despite say no guarantee dat dem go make am safely to deir desired destination, many waka abroad pipu dey take de risk and dem dey pay de costs. Dem dey often borrow from family members, or dem dey sell deir homes or businesses

If waka abroad pipu reach European shores, dem go most likely continue to travel to reach deir final destination. Travelling for Europe dey costly. For example, wan waka abroad persin tell The Migrant Project dat smugglers dey charge around USD 5,000 to travel from Calais in France to de United Kingdom.

Living costs around Europe fit dey different in many ways, but dem generally dey higher dan in de home kountries of waka abroad pipu. Unemployment among irregular waka abroad pipu for European kountries also dey high, so it dey difficult to pay off debts while persin dey try to pay living costs. Although waka abroad pipu wit a legal status fit benefit from state support to get healthcare, education and housing, irregular waka abroad pipu no dey eligible for dis assistance.

Learn more about life in Europe as a waka abroad persin

Make una share am on