Safe and Legal Alternatives for Nigerians

Everi year, thousands of pipu dey try to waka go anoda different country without a valid visa or permit. Many no dey fully aware of de financial, ohysical and psychological costs wey dey with say make dem choose to waka abroad irregularly. While some dey waste time and money, odas dey face abuse and exploitation, and some dey even lose deir lives for de waka.

Are you or someone una know dey consider travelling to anoda country to live and work without a valid visa? If so, make una read dis guide to find out more informate about safer alternatives, plus include accessing legal waka abroad channels and job opportunities for una home country.

Call awa waka abroad experts for real informate about waka abroad
From Monday to Friday (9am – 4pm)
If na for Yoruba, Pidgin, English +234 816 922 9349
If na English, Pidgin +234 806 163 7956
WhatsApp and messages also dey possible.
All calls dey confidential


Most European Union (EU) member states dey take part for inside a scheme called de wey dey try to EU Blue Card Work Visa Scheme get talented professionals from oda kountries. De EU Blue Card Network dey connect high skilled workers from outside of de EU wit European employers. If dem offer una a job, un fit dey eligible to apply for an EU Blue Card. Eligibility come depend on una work experience and education level.

EU Blue Card holders are granted entry and residence in advance which means they can travel safely and legally to the EU. In many cases, they can also bring their families and apply for permanent residence after a fixed period of time.

If dem accept una into Europena university and una fit pay de tuition fees, una fit dey eligible for a student vis wey let una study, travel and work part time for Europe.

A Student Schengen Visa dey allow non-EU students make dem stay for inside Schengen zone countries for up to three months. If una want to live and study in Europe for longer periods of time, una fit apply for a Long-Stay Study Visa for de relevant embassy for una country.

Even though de tuition fees for European universities fit dey cost, de cost of irregular waka abroad fit even be higher. Some universities dey offer scholarships for talented students.

Depending on de law of de specific country, living and studying for Europe fit put una for favourable position for applying for permanent residence.

If una dey strong academically, but una no fit cover tuition fees, una fit consider to apply for educational scholarship scheme.

With scholarship, una fit apply for a student visa wey fit allow una to live for de EU country wey de university dey located. Afta a fixed period of time, una fit dey able to apply for a different type of visa or for permanent residence.

Una fit read more about international scholarship opportunities here.

If a waka abroad persin don get refugee status or legal permanent residency for inside European kountry, it dey possible dat a spouse, parent or child fit dey able to join dem. Learn more about family reunification here.

Asylum na fundamental human right. Pipu wey dey run from direct persecution or serious harm for inside deir own country dey entitled to international protection. In general, UN member kountries and de UNHCR dey follow de rules wey dey outlined for inside de 1951 UN Refugee Convention to decide who dey qualifies for refugee status. Dis mean say dat asylum dey regulated by de same principles for inside most parts of de world. De EU Member States don establish a Common European Asylum System. Individual kountries also get deir own national laws and practice.

However, de rules about who dem go grant asylum dey strict. Very few Nigerians dey eligible since asylum dey granted to people who dey run from war and direct persecution, meaning most of de claims are rejected.

Learn more about wetin it mean to dey seek asylum for here.

Resettlement na de transfer of refugees from a kountry where dem don seek protection to anoda state wey don agree to give dem residence. Una fit find more information on resettlement here.

If una leave Nigeria and apply for asylum for anoda country, even if dat country no give una permission to stay, dere fit be chance say dem go relocate una to a third country where una fit live and work safely and legally. However, normally Nigerians just dey be small part of de total numba of resettlement cases.

Although Europe na de popular destination for waka abroad pipu, una fit find jobs and opportunities to make money for oda regions around de world. Rather dan make una take de risk of irregular waka, Nigerians get de option to travel legally and work for oda kountries for inside de ECOWAS region. ECOWAS include Benin, Burkina Faso, Cabo Verde, Côte d’Ivoire, De Gambia, Ghana, Guinea, Guinea Bissau, Liberia, Mali, Niger, Nigeria, Senegal, Sierra Leone and Togo.

If una dey ambitious and hard working, una fit don already get de skills wey una need to succeed without leaving Nigeria. Irregular waka abroad dey cost plenty money. Rather dan make una spend dis money on pipu smuggler, with de risk of losing everytin on de way to an unknown country, investing for inside small business for de local area fit change a potential waka abroad persin’s life for home.

For example, de EU’s Emergency Trust Fund for Africa dey offer a numba of programmes wey dey aimed at supporting displaced Nigerians as well as long-term sustainable development. Dere be seven ongoing projects right now for Nigeria wey dey worth nearly EUR 80 million. Programme objectives include promoting access to livelihoods, improving de quality of available services and enhancing community safety.

De World Bank dey fund de Nigeria Subsidy Reinvestment and Empowerment Programme, wey dey provide jobs and internships for young Nigerians.

De Lagos State Employment Trust Fund dey established in 2016 to provide financial support to Lagos residents who wan start and expand deir business. De fund dey focus on firing and promoting entrepreneurship by improving access wey dey to get funds and it dey for developing programmes wey go hepp to train and place unemployed Lagos residents for jobs.

Dere be many oda programmes and funding sources wey dey available for Nigerians who wan build deir skills or start business, weda for rural area or for de cities.

If na studying or starting business no be de right choice for una, dere be plenty opportunities for de cities of Nigeria. Wateva dem be, de skills of a Nigerian wey dey live for de rural areas dey more likely in demand for place like Lagos, Port Harcourt or Kano dan for Berlin or London.

Make una share am on