Life in Europe as a Nigerian Waka Abroad Persin
Many irregular waka abroad pipu dey go on de wak to Europe with de hope say dem go build beta future. Howeva, de reality wey dey ground often dey different and most no dey sabi de challenges dem fit face wen dem reach Europe. Between April 2017 and June 2019 na total of 14,036 Nigerians wey accept de chance to return home unda de International Organization for Migration’s (IOM) Assisted Voluntary Returnees Programme. Make una read on to sabi more informate about life as an irregular waka abroad persin or persin wey dey find asylum for inside Europe.
Call awa waka abroad experts for real informate about waka abroad
From Monday to Friday (9am – 4pm)
If na for Yoruba, Pidgin, English +234 816 922 9349
If na English, Pidgin +234 806 163 7956
WhatsApp and messages also dey possible.
All calls dey confidential
A persin wey dey find asylum na someone wey dey apply for international protection and refugee status for anoda country. For de whole, because Nigeria no dey at war and de government no dey systematically persecute de citizens, Nigerians no dey eligible for asylum. Nigerian application for asylum na im get de highest rate for rejection for among all African nationals wey dey arrive for Europe. For February 2018, Germany announce say it go send 12,000 Nigerians home and dat 99 per cent of Nigerian asylum claims fit dey likely to be rejected. Sabi more about pipu wey dey find asylum and oda important waka abroad words.
Asylum procedures dey different all across Europe, and it dey depend on de national law of each country. European Union asylum law talk say EU member states must to protect de rights of pipu wey dey find asylum. Dis mean say everyone wey dey in need get assurance of a fair asylum application process, and kountries dey required to provide pipu wey dey find asylum with accommodation and essential items. For some cases, pipu wey dey find asylum dey get vouchers but rarely na im dem dey get cash payments.
De Dublin Regulation, an EU law, mean say many pipu wey dey find asylum na de responsibility of de first European country dem reach. Dis mean say if dem don arrive in wan European state and come move to oda kountries dem face say dem fit send dem back to de first state where dem arrive. De Dublin Regulation also mean say asylum seekers no get to be given de choice of which country go check deir claim for asylum, or which wan dem go live or where dem fit put dem for inside dat kountry.
Asylum application process fit take a long time. Although most kountries dey try to finish cases within six months, dem dey often extend dis period, especially for times wey de volume of applications high.
Asylum applications fit dey difficult and complex. While some applicants dey successful, odas ni dey get asylum, which mean say dey must to leave de country where dem apply for international protection. For some cases, dem go hold dem for inside detention centres until dem return dem to deir country of origin. Pipu wey dey find asylum wey dem don reject deir claim get right to appeal de decision. Dose wey dem accept go get residence permit which go allow dem to work for a fixed amount of time before their case is reviewed.
Economic waka abroad pipu dey travel to anoda country to improve deir chance to make more money. Dem no dey entitled to asylum and dem no fit stay in Europe if dem enta irregularly. Many economic waka abroad pipu travel to Europe because dem believe say dem go make more money dere, but dem go come dey struggle to find job to pay back wetin dem owe or to send money home to support deir family.
While some waka abroad pipu dey successful for finding work abroad, odas dey face challenges trying to find work for dere.
De European employment market dey very formal. Persin wey dey find work must get official documentation, wey be such as passports, diplomas and work visa in order make im find work. It dey illegal make companies employ pipu wey no get valid work permits. Dem be special law enforcement agencies wey dey carry out inspections regularly to make sure say companies no dey employ pipu wey lack correct documentation.
De unemployment rate dey high for some European countries, particularly for young people wey get little work experience, education or qualifications. Plenti times waka abroad pipu no get de necessary skills to get jobs for Europe as de type of jobs wey dey available dey different from wetin dey deir home countries, and qualifications from abroad no dey necessarily recognised by employers. In order to find work, it dey important to sabi how to speak and write for de language of de destination kountry.
Even for refugees wey dey allowed to work for countries where unemployment no be problem, it fit dey hard. For a waka abroad complex for northern Italy for example, 90 per cent of de refugees dey unemployed. One African waka abroad persin talk say he don dey Italy since 2011 but im no fit find work and im dey survive by taking food from de dustbin. Germany get strong economy and unemployment na just 5% for 2018, but for refugees that figure na 40%.
While jobs in Europe go usually offer higher salary dan wetin go normally dey for a typical waka abroad persin’s country of origin like Nigeria, de cost of living also dey higher. De daily living cost for Europe, like accommodation, transport and food, dey very high. For example, de average household for de United Kingdom spend around USD 735 per week for 2018. Sabi more about de financial risks of irregular waka abroad.
Unda EU law, pipu wey dey find asylum dey get provided with housing. Although accommodation for persin wey dey find asylum fit remove some financial pressure, waka abroad pipu wey dem house for dese facilities dey often face oda challenges. Often pipu wey dey find asylum no get choice as to where dem go send dem and sometimes dem dey move dem from location to location. Some fit dey housed for remote areas or far from friends or relatives who dey live in de host country. As a result, many waka abroad pipu dey feel alone for inside dose facilities. Once persin wey dey find asylum get refugee status, for many cases, dem go lose de right to stay for asylum seeker centres and dem go need to find deir own place to live.
Irregular waka abroad pipu no dey eligible for accommodation assistance, which mean say dem dey responsible for finding de place where dem go stay as soon as dem go arrive for Europe. As dere be shortage of social housing for some European kountries, waka abroad pipu may have to rent private properties. Dis dey costly and dey leave many waka abroad pipu open to cheating by landlords who go give dem poor housing at high price.
Many waka abroad pipu take risky ogbonge route to Europe and dis dey put deir health and safety for risk. Many irregular waka abroad pipu and pipu wey dey find asylum who arrive for Europe dey need medical assistance and psychological support.
Pipu wey dey find asylum and irregular waka abroad pipu dey face restriction getting free healthcare for many European kountries. Usually, irregular waka abroad pipu fit only get free treatment if dem dey suffer from urgent and life-threatening mata. Odawise dem go need to pay for medical assistance and price fit dey very high
University education no dey free normally for Europe. While some irregular waka abroad pipu fit dey eligible to apply for a university scholarship or student visa wey let una study for Europe, odas no fit afford de high school fees for European universities. Dis dey make am difficult for waka abroad pipu to get de right qualifications and skills wey go allow dem get well-paid, high-skilled jobs. As a result, many waka abroad pipu dey struggle to make money wey dem go use to support demselves. Sabi more about safe and legal alternatives.
Waka abroad pipu wey don study for deir home kountries must bring de official documentation from deir academic institution t prove deir qualifications on order make dem get work. Some employers no go recognise foreign qualification but waka abroad persin fit pay make dem translate and validate deir qualification for Europe.
Integrating into European society fit get challenge. While some waka abroad pipu don adapt to deir new life in Europe odas dey struggle to integrate due to language and cultural barriers, and may face discrimination from members of de local community. Many waka abroad families dey find it hard to integrate into deir new culture while dey dey try to maintain deir home country’s cultural values.
Some waka abroad pipu dey hope to bring deir families to Europe once dem grant dem permission to stay. While some of dese applications dey successful, family reunion petitions must pass thru lengthy and rigorous procedures. Sabi more about family reunification.
Some irregular waka abroad pipu fit get caught by de authorities for Europe and returned to deir home country if dem no dey eligible for asylum or dem enter European kountry without a valid visa.
It fit dey difficult for returnees to reintegrate into deir home communities, especially if dem don spend many years abroad and some waka abroad pipu fit face discrimination.
When irregular waka abroad trial fail, waka abroad pipu dey express feelings of regret. Dem dey often talk say deir relatives dey angry with dem for having wasted time and money on an unsuccessful trip.